WHY I NO GO SCHOOL?
BY: GABLA GODWIN
Daddy, E no be you tell me say school be poison?
E no be you tell me say if man go school, E
Go turn devil for society?
E no be you again tell me say E be curse say man
for leave grass then go chase pen and paper?
Daddy, E no be you make I know say the beginning of
maturity be say man for know how to shoot gun?
So weytin be my own now
If Godsway get car wey
Me, I never get metaliki horse?
Daddy, So you know say E be person way dey write
Letter send give another?
Abi you never forget say E be person way dey cure
Person for hospital?
Daddy, E get one thing way I want talk you today;
That thing be the same thing way don dey kill my joy since
That thing as E be, na question:
Daddy, why I no go school?
Daddy, I know say na the best you dey find give me
E be im make you never make I turn devil
For society, E no be so?
Daddy, E no be say you want make I progress
Im make you make I no go school?
So as E be so, wey I don progress
From one wife to five in two years,
E don dey happy you?
Na joy for be your song as you get
Say I don turn best palm wine boozer
For the village
Or E no be you talk say, na the joy of a father
If im pikin turn hero?
Shebi I turn hero na!
In fact, Daddy, I no know why
You make your heart dey bleed;
E no be you for be the happiest person
For earth?
E no be you for dey jump
Like dog way don chop sati?
Daddy, if E no be so,
Then why I no go school?
GGABLA
�2017-01-31
#say_No_To_Occultism
#Ggabla
No comments:
Post a Comment